JONZING MAILS

BITS'N'BITES

Dear Val,
We no longer accept Blackberry Smartphones ( except Blackberry empathy), iPhone,  iPad, Brazilian hair, unnecessary trips (except na Bahamas), teddy bears, flowers as valentine's gifts.
Just come say hi to our parents.

PS: And you girls dey there dey form "I am sophisticated, una mate dey marry at 18 oooo".




Yours faithfully
Spinsters.

A.S.U.U (N)




Check out this conversation between a guy and a chic;

Guy: Sup chic, hw far nah...u dey fat oh!
Chic: Which kain talk b dat nah, as I sexy so! My broda I dey house nah, I must chop.
Guy: Well na true sha,,buh r u sure u r ok?
Chic: I no go lie giv u, ds strike just dey torment me, I no fit think or use my life do better thing.
Guy: No worry, e go beta.
Chic: Abegi, since dem borne me na wetin I dey hear,e go beta, e go beta...u say I fat, I fresh, u no notice say house don give me belle abi.

PS: A.S.U.U abi na ASUU(N) (goat meat)...for una mind una dey use people future flex abi, like say
       una dey chop asuun,,,,God pass una oh!no wonder no a.s.u.u person dey fine na nemesis b dat.
PLEASE HELP THE FUTURE OF OUR LEADERS OF TUMAO.








WETIN X-BOX 360 KINECT/WII AND PS 4 GAME DON TURN MEN INTO

Wife: Honey food don ready
(Silence)
Wife: Papa Akin I say food don ready
Husband and friend: (mumbles)
Wife: Dis kain man sef...u no go come chop?
Husband: Iyalaya Sub Zero....e go hear am frm me 2day
Friend; Oya chop am....(come hereeee) 

Computer games don make many people dance Alanta, Suo and Azonto join.....CONFIRMed JONZING!!!

No comments:

Post a Comment